A story: my new area iv

10 36
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Where I wan start so, party don scatter DJ don run sorry collect slap and now sound system don lost. . .I remember say na the song wey I dey play before party scatter truly be dat. Who send Joeboy make e sing this kind bad song so.

I knock dem mama chidi house, I ask, dem no see my sound system. . .oga pay me my balance, this man no wan gree o, e say party no finish. This man wan see my madness be dat but wait make I find my sound system first. Next I go AY room, without knocking I barge inside. The guy dey smooch one girl, I no even care I ask am for my sound system straight. Him sef no see am. I don check all the rooms, down to ustaz and Babatunde, no show. I don die for Suleiman hand.

Thank God for the rice and maltina wey I been come hide for room, na vex I go use chop the food today make I dey think of story to tell Suleiman concerning him sound system. As I begin chop, I hear knock for my door, I think say na police done show back, I dey find where to hide for my room but nothing even dey to hide for the back, so I answered in almost a whisper, who dey there? It's me your neighbor, a feminine voice replied.

I walked towards the door and opened, guess who? Zainab was standing there with the sound system and my laptop sorry desktop charger. I no even know wetin excite me, whether na the sound system or na Zainab. Anyway this party no too bad sha, as I don make new friend and my sound system no lost.

Baba Chidi dey owe me 4k as in four thousand naira and him wan joke with me. Make I go show am madness was all I could think all through the night. First thing in the morning, I don reach there, e be like say him see the seriousness for my eyes and without argument, him give me my money straight. We move as the popular saying goes.

Back in my room, I meet my phone dey ring, na mumcy dey call me. After exchanging pleasantries, she say she and popsy wan come see my new place. How can I allow them come and see me in such a mess? I quickly tell her say I no dey house as the new church wey I dey attend dey do retreat and na there I dey almost base now. I could hear the surprise in her voice cos na force she dey force me go church for house. God be with you son, na so call take end. I don escape this one.

Usta came back home after two days, him come dey ask me of my body, I tell am say I no sick o, e say him hear say police slap me. . .ah!! I don cast for this compound. Who tell you? Him say na babatunde. I just hiss tell am say na rumor, we just gist small and him tell me how him take escape.

Eli sef don finish honeymoon as her boyfriend don go, she sef see me dey ask me how body, who tell you say I dey sick? Na Babatunde tell us say dem slap you o. Ha!!! I need to deal with this Babatunde if not na so the whole area go soon know say dem slap me.

Babatunde, I dey respect you for this compound o, why you go dey tell everybody say police slap me, nawa for you o, na woman you suppose be because this kind thing wey you dey do no good. No vex, na dem ask me that's why I tell dem. Bros abeg stop this kind thing, I no go like make me and you get issue for this compound. No vex my guy. We shook hands and I went back to my room.

Make I plug my laptop use watch film before dem carry light, na 7pm be dis and na 9 dem go carry light so I fit watch one movie finish. Who dey knock my door so? Who is there? Una fit guess who na, make I go open door

To be continued. . .

9
$ 0.41
$ 0.41 from @TheRandomRewarder
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Comments

That your area will make sense, truth be told

$ 0.00
3 years ago

Your area na packaging

$ 0.00
3 years ago

This is an area you'd love to live

$ 0.00
3 years ago

If na my area people ware u no invite na them go plenty for your party pass

$ 0.00
3 years ago

E get some kind party way me dey like

$ 0.00
3 years ago

Your area is so enticing to live in.

$ 0.00
3 years ago

I go like visit this your area

$ 0.00
3 years ago

😁 Wahala everywhere

$ 0.00
3 years ago

Lol this your area self

$ 0.00
3 years ago

Wow cool story, will be waiting for the continuation, lol, I like were it's going.

$ 0.00
3 years ago