A story: my new area v

8 40
Avatar for Darniejhay
3 years ago

I open door see say na Eli. . .mtcheew I hissed, wetin happen I asked, she say she dey bored and she wan come gist with me. For my mind I say so na me Sabi gist and dat other guy sabi do the do. Anyway come inside, na film I wan watch. She came inside and lay down on my bed and I begin dey play game of thrones. Even though the series don try, e get why I play that movie. Innocent aspiring Reverend father like me.

Things happen sha, I get some accesses and I was denied some. Make una no ask too much questions but one thing is sure now, Eli no go too hard for me but no be she be my target. Na Zainab.

Next day I return Suleiman sound system, come still box am five hundred naira, at all at all na him bad pass. On my way back home, I met AY with one babe like dat, the babe no even fine sef, I just greet dem dey go na so h call me say I no say hi to him babe. Dis babe wey her mouth long like shrew so? Na for my mind I ask the question o, I reach there give the girl hand, na so this babe wan dey form over familiarity, if only she knows my thoughts towards her.

Papa Benji you must to kill me today, I no go gree again. . .na the shout wey I dey hear from the other compound as I dey near house be that. Make I branch go look make dem no come tell me story. Na so I branch see mama Benji hold papa Benji trouser, him sef hold her blouse. I no be bad person but I know say this fight go sweet to watch before I know fight don start, compound people don come separate, me sef form good boy say make I go separate, from no where, whether na blow abi na stick, I no even know but wetin happen be say I hear something land for my head na so I blank out.

I sha wake up after sometime see say na chemist I dey, dem sha tell me say I faint. Ah! From separating fight again? If u see the way dem wrap bandage for my head, I say make dem give me my cloth, na so I see say my shirt soak with blood. Me wey no get blood, how this amount of blood take comot from my head.

Only me walka dey go house na so area people just dey shout sorry Bros, eiya, thank God say nothing do you o. . .all those kind comments, na there I know say I don truly cast for area. I need a break from this area was what I told myself. I reach house, I no even see my key, na so compound people dey tell me sorry as I sit down outside dey think how I go take spoil my key.

Come inside before you figure what to do at least so you can relax, one sweet voice wey I hear dey tell me, na Zainab o, good things do happen sometimes, but make I no too look desperate, I said don't worry, I'll be fine, but she still give me the offer second time, I no wait again o, na so I fall in her crib.

To be continued. . .

7
$ 0.00
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Comments

Lol.... You no strong reach you go hold fight, next time you go japa!

$ 0.00
3 years ago

Lolz nice area

$ 0.00
3 years ago

Ahahaha... Very entertaining,love your sense of humor in putting together this write up.

$ 0.00
3 years ago

So are you still living in the area or you want to leave?

$ 0.00
3 years ago

So this your story about your new area never finish abi??

$ 0.00
3 years ago

Hmm is very nice article but Eli is he afraid and he doing that ?

$ 0.00
3 years ago

Bad guy. See wetin neighborliness do you, next time you go observe from distance. Na so I take go collect blow wey nor be my own.

$ 0.00
3 years ago

Lol. . . separating fight na risk o

$ 0.00
3 years ago