A story: My new area iii

7 42
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Las las I see sound system borrow from Suleiman, my home boy. That guy always got my back after I don drop 1k promise am say I go bring food from part for am.

I no even know as the day take go, as wetin dey my mind na make time for party reach make I see food chop, play music and collect money. Time is 2pm, I don go the next compound, set my sound system, connect am with my laptop don dey drop some kind music but I no gree go far from there because I no trust anybody.

4pm, naming start with church members coming to pray. As I no get gospel music apart from 'Ekueme', i just put the song on repeat, come see as church people dey eye me o, after all that song as pesin talk fit make person return looted palliative with tears for dem eyes. One bro come meet me say make him send me gospel songs, I come gree o. See busy body Bros, my laptop wey don turn desktop wey I dey use form, na so the guy remove my charger, laptop off. Una need to see the eyes wey I take look the bros, him just dey apologize.

After church people go, na so I start to dey play music, people dey dance, I dey feel like one important DJ. I look crowd na so I see zainab, that girl wey dey my compound. I dey rep my compound people and dem dey proud. Ustaz was there too, plenty food and shayo to go round. All wetin I dey do na to just change music.

People don shayo, na so some guys bring out weed , d whole place just dey boom of music, alcohol and weed. Everywhere just dey make sense before I know, na so I see people dey run. Wetin dey happen, I no even care to ask or know, na so I remove charger from laptop, join the race o, na police don come raid.

I for escape o, but I remember say Suleiman sound system dey there and I don promise am say nothing go happen. I no get choice than to come back. I reach compound na so I dey sneak make I go enter my room like say I no know wetin dey happen. Next thing wey I hear na hold it there!!!

I just pause like tv game, the officer jack my trouser dey call him colleague say him don catch the DJ and the DJ na Yahoo boy. Double wahala.

Officer abeg I no be Yahoo boy was the only thing I could say before the guy deaf me. Aswear that man get degree for slap. I see stars, in short, nothing I no see. Where your room, na the next thing wey I hear, I pointed all the rooms for the compound because I no even remember my own room. At last we enter my room after dem see say nothing even dey the room, dem say make I bail myself. But officer, bail is free na and besides I no do anything, na for my mind I talk am o. At last dem collect four thousand naira from my hand come free me.

Headache dey worry me and I no dey even too hear sef, wetin I remember na sound system. I enter the next compound, I no see my sound system, I look around to no avail. Sound system don lost o, another wahala

To be continued. . .

10
$ 0.76
$ 0.76 from @TheRandomRewarder
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Comments

Nice one

$ 0.00
3 years ago

Things dey sup for this compound sha, I never even too explore the area

$ 0.00
3 years ago

This is a very fascinating story, I can't wait to get to read the concluding part of the story.... Kudos

$ 0.00
3 years ago

What happens next?

$ 0.00
3 years ago

Nice drama, keep it up.. We are following

$ 0.00
3 years ago

These choke everywhere,keep it up bro I'm particularly enjoying this ur drama

$ 0.00
3 years ago

Hmm. I dey feel this your vibe

$ 0.00
3 years ago