A story: my new area ii

8 41
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Eli Sabi cook no be small, I dey suspect say she even go catering school but what do I care? Na food me just want chop. She cooked rice and beans and I must confess it's very tasty, abi na because I never too chop better food sha. After Eli don wish my food, I say make I stay chop with her, na so one guy enter compound, una need to see as Eli run go jump on the guy, I nearly run follow the other door as I think say na thief don show but na Eli boyfriend. The guy tall, get chest like wrestler and him fine smooth face come compliment him body structure.

Well it's time to go, I carry my food enter my room go chop. But my curiosity no allow me o, I say make I go listen to updates na so I pass Eli room. Wetin I hear, na only me still dey imagine am. As e don be now, I really need to concentrate on becoming a Reverend father. I went back to my room to rest but I was restless so I just decide to go stroll.

Dem get one uncompleted building wey dey our area, as I dey pass, I begin dey smell weed from the building, me wey Sabi fear smokers like dis, make I turn dey go back house to avoid stories that touch, na so I hear pesin dey call my name. Guess who guys, na ustaz o, ustaz na bad boy. . .

I enter the next compound make I dey acquainted with my neighbors, na so I see say dem dey cook plenty food, e be like say party wan happen here o. As I ask, dem tell me say na mama Chidi dey do naming today and party na dis evening but one problem dey, dem never see DJ hire cos of their low budget. Make una no even go far sef, me na DJ. Work wey I do for school till I graduate.

Me and baba Chidi negotiate, him later agree to pay 10k and na him generator set we go use. My compound people go soon witness my many talents. Na where to go borrow sound system remain o. Make I go scout the rooms maybe I go see borrow, if not, na to call some of my friends after all my laptop wey don turn desktop still dey and I get music choke am. DJ darniejhay on the beat.

I forgot to mention the other lady for our compound wey I no know her name, I don ask and her name na Zainab. My people, make I no lie that girl set pass all the other girls wey dey our area but she no dey talk and even mingle with people. Other info wey I get about her be say na sales rep for one of those big malls. I must become friends with this girl o, so dat I go dey get discount wen I go buy something from their mall. . .u guessed right now be only mall, where I wan get the money to go the mall from? I wan chyke the babe after all I be fine boy small.

Make I go borrow sound system, I go update una as the party go later, gist full this new area, make una stay tuned. DJ darniejhay signing out.

9
$ 1.45
$ 1.45 from @TheRandomRewarder
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Comments

Area sweet o

$ 0.00
3 years ago

THis yor area go get mad fun o.

$ 0.00
3 years ago

I think you should take things easy for this your new area make big boys no talk say you dey flex muscle.

$ 0.00
3 years ago

Your new area is full of vibes i think

$ 0.00
3 years ago

Me I gbadun the way you use naija pigin for this write ups

$ 0.00
3 years ago

I like the way u dy proudly yarn with pigin English for here. Nice work

$ 0.00
3 years ago

Chai is okay that's good though .

$ 0.00
3 years ago

Pls ooo is like i want to move to this your new area ooo hahaha

$ 0.00
3 years ago