A story: My new area

10 43
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Well. . .my name as seen is Daniel but I go by my nickname darniejhay, not many know me by that name though as na name wey only my friends dey call me. Wen I say friends, I mean my real homies wey we start together. I be graduate from one of these universities o, even though for my mind I know book ehn, na by force I take graduate. All my lecturers hate me, though no be their fault, na because dem feel say I no too Sabi book so dem dey always fail me. I go gist una about my University days supsiquently as the story dey go. Please pardon my use of English, na mathematics I read for school.

After service wey man no see work do, na hustle be the next thing, no ask me how I dey hustle, I just know say I Sabi do any and every work even though I no go do am well, I go sha try my best to make sure say I fix your small problem, only be say another one wey big pass that problem fit sup base on my previous work. I be mechanic, tailor, plumber, carpenter, just name it, I get idea.

Staying with my parents has become stressful even though dem no dey complain, dem don dey send a whole Aluta dragon go buy salt and pepper. Na so I go buy pepper one day I come see one girl wey I been dey eye those days. The matter for no too pain me if to say I never buy the pepper o, but I just buy pepper finish, hold am for hand na so the girl tap my shoulder. Caught in the act abi, girl wey I been don lie for those days say I be ajebo. I just do like say no be me to avoid further embarrassment based on say the girl stop her ride come catch me abi na caught me unawares. Anyway na that day I decide say I dey leave our house make see finish no too much.

I gather money from my plenty jobs, at least as I feel say I get 100k like dis na big boy accommodation I go rent at least all those babes wey I no dey fit carry come house go dey visit now. I met one agent who promised to help me get a house. Three days later, him call me say house don show. I go see the house ehn. . .my brothers, I nearly cry, dem say I go dey share toilet with like six people, we go share kitchen too the house na typical face me I face you, but how man go do na, we gaz move. Based on low budget things na, I pay 65k for the house after every every na so I tell my parents say me wan move o, how dem go do than give their blessings?

I no get money to buy mattress na so I carry the one wey dey house, anyhow sha, I pimp the room with the remaining 35k, low budget pimping o, na so I move in one Sunday night even though almost everything wey I carry go the house, na from our family house I carry am.

Well I'm now living on my own and no be small thing, I miss house o as hunger nearly wound me, if na for house now, I for don find something chop but base on man wey I be, I suppose make new friends sharp sharp before hunger do pursue me go back house.

My new area na typical ghetto o, make I tell una about my neighbors first, the one wey him room dey face my own directly na AY, short form of wetin I no know o, d guy na chronic womanizer, different sound track every night, e no dey allow me concentrate wen I dey read Bible. Mtcheew. . .me wey wan be Reverend father na so this guy go dey make me reason bad bad things. There are also Loveth, corper and him corper girlfriend AKA Mr and Mrs corper, Babatunde the chief gossip, dis guy get news about any and every happening both within and without the area, Elizabeth aka Eli Eli, Usman the ustaz and one other lady like dat wey I never know her name.

This compound go sweet die as Eli don give me food chop this evening, based on say I be new comer, dem dey pamper me yet, dem never know wetin wan befall them for this compound. I forgot to say there are other compounds sorrounding our compounds, and I hear say na our landlord own the whole compound there. This man na silent millionaire but I hear as e dey change am for ustaz because him never pay nepa bill. I dey laugh o, because person wey no see food chop, wetin him wan use light do?

Eli don dey cook o, make I go follow her gist small, in case something go sup

12
$ 0.76
$ 0.76 from @TheRandomRewarder
Avatar for Darniejhay
3 years ago

Comments

The area looks promising though

$ 0.00
3 years ago

I just moved to a new area after I spent over five years at my former side.

$ 0.00
3 years ago

Life is a journey, keep going

$ 0.00
3 years ago

Me the new area I wish to live in is island part of lagos

$ 0.00
3 years ago

Sounds like an interesting place to live

$ 0.00
3 years ago

Let's see how this would end. Hope you find luck in your new area. Peace

$ 0.00
3 years ago

Hahaha nor go chop winch ooo... Nice one

$ 0.00
3 years ago

Hmmm something is telling me that the bot might seems to punish for some action sort of

$ 0.00
3 years ago

If you ask me this is not a short story/tale. 🤔

$ 0.00
3 years ago

If you ask me this is not a short story/tale. 🤔

$ 0.00
3 years ago