Look and Laugh

16 35
Avatar for RandomBloger
3 years ago

I wrote this poet yesterday night, all the way from my country.

***Make you bring your ears,

Make I yarn my experience for here.

Look my country

Naso foreign things full inside,

Government copying all oyinbo styles,

Our own things wey e dey

Go be very useless things,

No planning,

Senseless thinking,

Leaders wey no dey smart enough

To know say

Culture Na the base of the society.

African cultures,

Socialist or communal mindset

Na way of progress for black people

Not the senseless thinking of these leaders

To dey follow follow òyìnbó man.

For my country Na book of 1809

Dem dey use judge case of 2020.

I look and laugh,

Looku media,

Radio, television and the papers,

Nasoso big big English government go dei Talk,

Yet poor man dey plenty more and more,

Economy crumbling everyday,

Independence Na 1960

But since then light e no dey,

Since when dem born me for year 2000

My country never still get light for 24 hours,

Since when dem born me 20 years ago

I never hear say Nigeria good before,

Na "e go better" be the national anthem.

I must laugh,

When politricksians are getting richer,

Nothing for the hardworking man

For my country,

Police uniform dey important pass food

For this country.

I dey looku looku,

I dey laffu laffu,

Wetyn man go do when Na for our eye o

Lai muhammed go CNN

Like him name o him begin dey lie o,

Him say government don provide ten thousand jobs for the youth o,

But wetyn dey happen if you go for the streets?

Plenty graduates dey roam about

No job to give dem now,

First class graduate dey push wheel barrow,

Some Na bricklayer,

The one wey dey stay near my house Na conductor for molue driver

Wey himself be university graduate,

Buhari con go gather pressmen,

Him begin dey tell them say Nigerian youths are lazy.

I look and laugh as country treasury don turn private property

While the people live in abject poverty.

I no fit cry again because Na waste of cry be that e o,

Tears don finish for my eyes

So I must look and laugh,

Soldier don rule us before,

Na politricksians turn we been day,

Different circles and promises

But Nigeria still dey where e dey

Poor man still dey suffer,

I must look and laugh,

I must look and laugh,

Laffu laffu laffu!

Looku looku looku!!

I dey looku!

I dey laffu !!

I chuckle too!!!

12
$ 0.03
$ 0.03 from @TheRandomRewarder
Avatar for RandomBloger
3 years ago

Comments

I read through it, Wrote a very interesting poem. So lovely Look and laugh. Nice write up.

$ 0.00
3 years ago

Thanks a lot, I appreciate your valuable comment, this serves as an encouragement for me.

$ 0.00
3 years ago

Wonderful article thanks for sharing

$ 0.00
3 years ago

Thank you too

$ 0.00
3 years ago

I reside in a region where the governance is of no mercy to the poor citizens only failed promises at the end of every campeing

$ 0.00
3 years ago

This is a situation of sadness and anguish may our leaders find the truth soon and change for the better.

$ 0.00
3 years ago

Laughter is a kind of medicine that help is keep going, nice one.

$ 0.00
3 years ago

Sure laughter is a medicine for the heart and it nourishes the soul. Thank you

$ 0.00
3 years ago

This is really amazing

$ 0.00
3 years ago

Thank you. Amazing too

$ 0.00
3 years ago

I must say, this is really amazing

$ 0.00
3 years ago

Thank you

$ 0.00
3 years ago