Problem No Dey Finish.

2 20
Avatar for Estodus
3 years ago
Topics: Pidgin, Poem

This life an turn by turn

Life na set up and sometimes

E go make you mess up

Problem no dey finish

Hold your image make you no tarnish am

You get money, problem dey

You no get money, problem yapa

Make una enjoy the little wey you have

People plenty wey dey lost happiness

On top wetin dem no get

Problem no dey finish for this life

You dey look for a wife

Problem dey and you find am

Problem go still dey

Enjoy your life the way you can

Help people wey you fit help

No lose yourself trying to fix everything

Problem no dey finish for this life

Problem no dey finish my brother,

Abeg if things dey hard

Try to dey take am slow for your side.

Why you dey do like say life go end

If wetin you dey plan no happen?

Why you dey fear wetin wey never happen yet

Because you dey see people wey dey fail?

Elders wey talk say life na upandan no talk wrong

If life push you down

Abeg play for the mud small make you regain energy

Me sef sabi say life dey get patch patch

Because I dey try stitch my own together

But e no mean say make I no dey laugh.

You dey ask why? Na Because problem no dey finish

And we go dey alright las las...

2
$ 0.00

Comments

This is really nice.

$ 0.00
3 years ago

This is really nice.

$ 0.00
3 years ago