With all the kyn fyn fyn monikers wey you go see for this platform, e go hard to know who be your brother and who be passerby. Even my own moniker sef de confuse me sef sometimes. Abeg no mind the moniker, I be naija guy wey de inside naija de roast like this. I been wake up one early morning, stumble ontop this site, na so I just reason say, which name I fit use run this level now, as i de shake head, na so morningstar enter my head, I say ok na, why not if not...
I don write all kinds of things for this platform take raise cash, some of them na real life experience, some I still garnish with small maggi and salt make e for sweet but this one now, na the second time wey I go write in Pidgin.
I de enjoy Pidgin die, sometimes sef, when I blow grammar for real life, I go come de feel bad say mehn, we get this kyn unique language, why we go de even speak English sef, why we no go just make this language our official language?
E no get anybody for naija wey no de enjoy Pidgin, I mean e go allow you feel free, talk wetin de ur mind,no be say you go de talk, de match break small small make you no go make mistake...LOL
Anyway sha, no be Pidgin matter I wan talk about, but everything still follow. I no really get anything in particular to talk about but I just wan test this jonsing bot wey de give person cheese for this platform, for sometime now, anything wey I write, e no go reason my matter and you know say deep down na money matter carry person come here, make I no lie.
I come observe say e get some articles wey dem use some kyn languages write wey de move market, like Philipino and Indo people wey de here, dem de write for their language e de sell, de jonsing bot de show them love, and I remember say de first piece wey I use Pidgin write, e been show me small love, I come say ok, e be like say na to change modus operandi, see how e go be. Shey you feel am?
I don even de reason to create a community for ourselves, for we wey de speak this language, if de community get enough number, de strong, de bot go still de visit articles wey dem drop under.
I don de reason dis matter for long but something just de hold me back, because Naija, sometime our matter too de strong, our competitive spirit strong die, so I de fear somehow about wetin to expect but las las, I go run am.
Mehn! Man get responsibilities full house and this small small thing wey we de see for here follow de help situation but no be my end goal be this, yes I de try small small for writing matter but writing de exhaust me die, each time wey I manage drop one article, body de do me like say I run marathon. Then come imagine wey I feel like this finish, this bot no go come gree give me money, no be die be that?
Me I wan increase my earnings for here, so I go fit raise enough cash take enter Crypto trading, that one na en be my end goal but the revenue no just de consistent at all.
I de read about one guy reviews about him earnings for February from all the Crypto blogging sites wey him de active on. This bros break down how him take earn around $2k7 CAD in just de month of February, no be play play money be that na. Although I know some of those sites wey him de earn from and I de write there too but I still de come up for the matter but this bros na veteran already.
Money wey I don make for leofinance.io, na how to take send the mumu token go where I go dissolve am into better coin na en come be wahala. That site sef too get wahala...power up, power down, delegate, curate etc. Them just de complicated I swear. I don ask two of our brothers wey de active for the platform make them show me how I go take collect my cheese, bros them just de.
My own na make I fyn wey take increase my earnings online na en de do me now, cos work no de offline. Offline hustle sef de cause depression, and e de involve too much waka waka and nyash kissing...I be bouncer and gym instructor, but work no de at the moment. Since wey Oga close down him club, bouncing jobs now na on contract...
Mehn!! I gats make am oO cos I don work both hard and smart but luck never shine just yet. Abeg make una like and sub make we move this ministry go front.
0
19