read.cash Log in
@Estodus more from that month

Problem No Dey Finish.

This life an turn by turn Life na set up and sometimes E go make you mess up Problem no dey finish Hold your image make you no tarnish am You get money, problem dey You no get money, problem yapa Make una enjoy the little wey you have People plenty wey dey lost happiness On top wetin dem no get Problem no dey finish for this life You dey look for a wife Problem dey and you find am Problem go still dey Enjoy your life the way you can Help people wey you fit help No lose yourself trying to fix everything Problem no dey finish for this life Problem no dey finish my brother, Abeg if things dey hard Try to dey take am slow for your side. Why you dey do like say life go end If wetin you dey plan no happen? Why you dey fear wetin wey never happen yet Because you dey see people wey dey fail? Elders wey talk say life na upandan no talk wrong If life push you down Abeg play for the mud small make you regain energy Me sef sabi say life dey get patch patch Because I dey try stitch my own together But e no mean say make I no dey laugh. You dey ask why? Na Because problem no dey finish And we go dey alright las las...

No comments yet

Log in to join in Reading is open to everyone. Replying needs an account.